2 of 61JESUS · 61 chapters

Birth of Jesus

Luke makes his introduction as the careful author of this Gospel. The angel Gabriel appears to Mary, a virgin in Nazareth. He announces to her that she has found favor with God and will give birth to Jesus, the Son of God. Through Jesus' birth, prophecies are fulfilled by the arrangement of events. God leaves no detail unnoticed. The same can be said of our own lives.

Ask yours

Bible Quotes

Share
Luke 1:1

Many have undertaken to compose an account of the things that have been fulfilled among us,

Berean Standard Bible

Public Domain

Read more...
Free Resources

Want to understand the Bible more deeply?

Join our Bible study

Transcript

Nigerian Pidgin English
I dey write you dis letter, my dear friend Theophilus, to tell you di way wen everytin take happun to us since, so dat you go no di main tin wen happun. Di time wey Caesar Augustus be king for Rome, and wen Herod di great be king for Judea, God come send one Angel Gabriel to one girl wey neva no man befor for di town wey dem dey call Nazareth. Di girl name na Mary. Mary, no fear, God dey for yor side. You go get belle and you go bon boy pickin and you go call 'im name, Jesus. How e go happun? I no no man! Di Holy Spirit go enta yor body; becos of dis, dem go call di holy Pickin, di Pickin of God. 'Im govment no go ever end. Na'im Mary come travel go one town wey be Judea go visit 'im sista, Elizabeth, wey God sef don make get belle. Elizabeth! Mary! My sista, Mary! Na you God bless pass all women. And di Pickin you go bon too. As I hear you salute me just now, pickin inside my belle jump wit happiness! My heart dey sing praise to my God, And my spirit happi for dis God wey save me. From now dey go, everybody go call me blessing. Make una hear me, every man from Nazareth, Caeser Augustus don put law down say, dem wan count everybody wey come from Galilee go reach Judea. And every man must go write him name down for di town and village wey dia papa come from. Mary go Bethlehem for Judea wit di man wey e wan marry, to go put down dia name. But no place for dem to stay for Bethlehem. Di only place wey dem see na where dem dey keep animal. Dis time, some people dey look after some sheep dat night for dat part of di country, na'im di angel of God come show 'imself to dem, na'im God light come shine waah for dem. Today so for David town, dem don born una Savior, Christ di Lord Di people wey dey look di animal come pick race go look di Pickin. Na dem first carry di good news of di mama wey no know man wit 'im Pickin.
JesusFilm