Na di likeness wey God get for everybody na'im make am send 'im only Pickin
so dat anybody wey believe am no go die, but go get life boku.
God no send 'im Pickin come world to come condemn we,
but so dat E go save we.
Today, Jesus Christ get pass one billion people wey dey follow am.
Four book for Bible na'im dem write as dis believe for Jesus take start.
Oder place for the Bible dem write oder tins and even di same tins wey happen for anoder way...
Dis na di tory for di book for Bible wey dem call Luke.
I dey write you dis letter, my dear friend Theophilus,
to tell you di way wen everytin take happun to us since,
so dat you go no di main tin wen happun.
Di time wey Caesar Augustus be king for Rome,
and wen Herod di great be king for Judea,
God come send one Angel Gabriel to one girl wey neva no man befor
for di town wey dem dey call Nazareth. Di girl name na Mary.
Mary, no fear, God dey for yor side.
You go get belle and you go bon boy pickin and you go call 'im name, Jesus.
How e go happun?
I no no man!
Di Holy Spirit go enta yor body;
becos of dis, dem go call di holy Pickin, di Pickin of God.
'Im govment no go ever end.
Na'im Mary come travel go one town wey be Judea go visit 'im sista, Elizabeth,
wey God sef don make get belle.
Elizabeth!
Mary!
My sista, Mary!
Na you God bless pass all women.
And di Pickin you go bon too.
As I hear you salute me just now,
pickin inside my belle
jump wit happiness!
My heart dey sing praise to my God,
And my spirit happi for dis God wey save me.
From now dey go, everybody go call me blessing.
Make una hear me, every man from Nazareth,
Caeser Augustus don put law down say, dem wan count everybody wey come from Galilee go reach Judea.
And every man must go write him name down for di town and village wey dia papa come from.
Mary go Bethlehem for Judea wit di man wey e wan marry, to go put down dia name.
But no place for dem to stay for Bethlehem. Di only place wey dem see na where dem dey keep animal.
Dis time, some people dey look after some sheep dat night for dat part of di country,
na'im di angel of God come show 'imself to dem, na'im God light come shine waah for dem.
Today so for David town, dem don born una Savior, Christ di Lord
Di people wey dey look di animal come pick race go look di Pickin.
Na dem first carry di good news of di mama wey no know man wit 'im Pickin.
After one week wen time reach for dem to circumcise di born-boy, dem come call am Jesus,
na'im Joseph wit Mary come karri di Pickin go Jerusalem to dedicate am to God.
E get one man wey like God work well well.
wey di Holy Spirit don promise before say e no go die until e see Christ. 'Im name na Simon.
God, I fit die kule now as I don see wetin you don talk before now.
Now, my eye don come see your freedom.
Dis pickin na God choose am.
God bless two of una.
So, wen dem don finish all dem get to do as Moses law tell dem to do,
dem leave Jerusalem come go back to Nazareth.
Wen Jesus be twelve years, Joseph wit Mary take am go Jerusalem for Passover.
After di feast, dem begin go house wit di mind say Jesus follow dem, but he stay for back.
Dem come go back go di town go look for am.
Wen tiri days don pass, dem come see am as e sidon wit Bible teachers and elders.
Who 'im pickin dey ask dis kain question?
E come from Nazareth.
We tink say e follow us.
I beg forgive am 'im too-know
Pipul wey hear am surprise.
My Pickin, why you come do us like dis? Me wit your papa don dey worry well well dey find you since.
Wetin make una dey fine Me? Una no know say I suppose to dey do my papa work?
And E come follow dem go Nazareth. E come dey grow well, E come get sense. God like am and people sef like am.
By di time wey fifteen years for king Tiberius govment don reach,
Da time, Pontius Pilate be di governor of Judea,
And Herod be di king for Galilee,
And Annas wit Caiphas dem be pastor,
God come talk to John for inside bush, na'im e come go di area around Jordan
dey preach say make dem comot hand from bad tin make God fit forgive dem dia wickedness.
Make una leave bad tin!
Den, come baptize!
And God go forgive una.
As dem write am put for di book wey prophet Isaiah write:
"Persin dey shout for inside desert
ready di road for di Master!
Make una clear road for am to pass
Every big hole must to cover,
every mountain must turn to ground!
Make di ben ben road straight and di jaga jaga road smooth.
Den everybody,
Go see God freedom!"
Wetin we go do?
Yes, tell us, wetin we must do?
All dis wicked people!
Wetin you want make we do?
Wetin you want make we do?
Person wey get two, shirt
must give one to di persin wey no get.
And person wey get food Musts share am.
Teacher,
We be tax collector. Wetin we go do?
No collect pass as law talk am.
And what of us naw? Wetin we go do?
No take by force take money from people.
No dey talk lie lie for person head.
Make your pay reach you.
Tell us...
na you
be Christ?
I baptize una wit wata.
But di Person wey e be say e big pass me day come.
I no even reach who go comot l'n shoe sef. Wen E come, E go baptize una wit Holy Ghost and wit fire.
E dey go pluck corn and wen E pluck am, E go troway di kanda and gada all di corn take.
Di pawa of God wey be di Holy Spirit come stand for Jesus head like dove.
One voice from heaven come say "You be my Pickin wey I love and I happi wit you!"
Wen Jesus start 'Im work, na thirty years E be.
E come back Jordan wit God pawa and di pawa come carry am go bush,
where devil come tempt am for forty days.
All dis time, E day for fasting, e no chop anytin.
And na'im devil tell am say:
If you be God Pickin, oya, turn dis stone to bread!
"Dem write am say,
No be only bread na'im person go take live, but wit God word.
Den devil come carry am go up, e come show am fiam, all di fine fine place for di world.
I go give you all dis pawa and all dis money.
Dem don give am to me and I fit give am to any person wey I like.
All dis go come be your own if you gree sarve me.
Dem write am say "Na only God you go worship.
Na only 'Im you go sarve."
Devil come take am go Jerusalem, come put am on top of di place wey high pass for di church.
If you be God Pickin, jump come down from here
Becos God Word talk am say "God go command 'n angel to take good care of you."
E still talk am say "Dem go carry you up so dat your leg no go fi nack any stone."
God Word talk say:
"Make anybody no try God at all."
Den E come come Nazareth, di place were E for grow.
How now?
I dey.
As E dey go before every Sabat, E come go church dat day.
Dem call am make e come read di place wey prophet Isaiah write for Bible.
"Di Spirit of God dey for my body
Becos E don choose me to bring beta news to di people.
E send me say make I go free people wey dey wahala and make people wey blind start to see.
To free di people wey don suffer taya.
And tell people say di time don reach wey God go save 'n people."
Na true talk.
Dis place of Bible don happen today o, as una don hear me now.
Bible na true o!
Na only di Savior na'im fit do wetin e talk!
How we go know?
I know say you fit quote proverb for me,
"Dokita, go cure yourself."
You go still tell me say,
"Oya make you do di tin for your own village
wey we hear say you do for Capernaum."
Make I tell you!
Dem no dey welcome prophet for 'im own home village!
Na dis word na'im Jesus take make dem know say nai'im be di person God send come save 'im people.
Dis Jew people no gree say na'im be di Savior.
Dem wan push am down for top of high hill
But e waka pass dem as dem many reach,
And go 'Im way
E come reach Capemaum, one town for Galilee.
Everywhere, e dey show say na di Roman dey govment,
and di people dey pray say make di person wey go free dem from dis wicked govment quick come .
I greet una.
Yes o, oga!
Your boat fit take me, Simon?
Why not?
E no wan comot now, abi?
E no wan comot now, abi?
Talk to us!
Jesus, talk to us!
E get one time like dat wen two men go church go pray
One na Pharisee, di oda one na tax collector.
Di Pharisee stand one side dey pray like dis:
"I tank God say I no get long throat or dey lie, or dey follow anoder man wife like the oder people.
I tank You say I no be like dat tax collector wey dey for there so.
Every week I dey fast two times.
I dey give you one part of ten tins wey I get.
And di tax collector stand far e no fit raise 'im face look heaven,
But e come put 'im hand for chest say,
"God sorry for me, I don do bad well well."
I tell you, na di tax collector God happi wit as dem comot, not di Pharisee.
Persin wey carry body na'im go shame,
person wey put body down,
God go carry am up.
Push di boat go di side wey di water deep.
Den make you and your friends trow una net to catch fish.
Oh Oga, we trow net taya last night,
We no catch fish!
But if you talk so,
I still fit trow di net!
James!
John!
James! John! Make una bring una boat here come help us, quick quick!
We no fit, our hand sef full O!
E don do! E don do!
Comot for were I dey, Oga!
I be bad man!
Make you no fear.
From now, na people you go dey catch.
Come mit me and hear word, hear me make you for get life.
Look for God now wey you fit see am; call am now wey e dey near.
Make wicked person leave wicked tin and di person wey dey tink bad clean 'im mind,
make e go back to God.
God go sorry for am. E go forgive am kpata kpata.
You go go wit happiness and e go lead you wit peace.
E dey come! E dey here! Look!
Jesus! Jesus!
I beg make you save my only daughter!
Oga, sorry for mi. She be only twelve years and she dey die. I beg! I beg follow me!
Jairus, sorry O.
Jesus!
Your daughter don die.
Make you no worry di teacher again.
Make you no fear.
Just believe, she go well.
No just cry.
She never die, na sleep she dey.
Pickin! Get up!
Give am sometin to chop.
I warn you:
No tell persin wetin happen.
After, e come see one man 'im name na Matthew Levi.
E sidon for di gate wen custom pipul dey collect money.
Follow Me.
Den Jesus come go up for di hill go pray, E spend di whole night dey pray to God.
And wen day break, E come greet di twelve of dem wey E call apostles.
Simon, wey E come call Peter...
And Andrew, 'im broada...
James...
and John...
Philip...
and Bartholomew...
and Matthew...
and Thomas...
James, di pickin of Alphaeus.
And Simon wey be Zealotes.
And Judas, di broada of James.
And Judas Iscariot wey go sell Jesus.
God bless poor people,
di kingdom of God na una own.
God bless una wey dey hungry now, una go belle full.
God bless una wey dey cry, una go laugh.
God bless una wen people hate, wen dem dey curse una. And dem come say una wicked, all becos of me.
Wen dis one happen, make una happi and dance. Becos na big gain na'im dey wait una for heaven.
Becos their grand grand papa do di same to oda prophet.
...sixteen, seventeen, eighteen, nineteen, twenty. Na all be dat.
Wetin you mean say na all be dat?
Wahala for people wey get money now,
Una don chop better life.
E no wan get money, abi e dey crase?
Wahala dey for una wey dey laugh now.
Becos una go cry.
Na wahala wen pipul dey talk good of you.
Na so their papa still talk di same tin about di lie lie prophet.
But make I tell una,
Love yor enemy.
Do good for dem wey hate you.
Bless dem wey curse you.
Pray for dem wey dey do you bad.
If person slap one side of yor face,
Let am slap di oda side too.
And if persin take yor coat, let am make e take yor shirt too.
Give to anybody wey beg you.
lf persin come take you own tin,
no ask for di tin back again.
Do to oda pipul only wetin you want anoda persin to do to you.
If you love only di pipul wey love you,
wetin go make God bless you?
Even bad people like only people wey like dem.
And if you do good to dem wey do good to you,
wetin go make God bless you?
Bad people sef dey do so.
Why e go touch am?
Why e go talk to am?
Yeye tin!
No,
love yor enemies,
and do good to dem.
Borrow make you no tink of gain.
And den you go get big gain,
becos una go come be God pickin.
Do good to dose wey no fit say tank you and wen wicked.
Get sorry heart,
Just as your Papa get sorry heart.
Save us, Jesus!
No judge, make dem no judge you.
No condem,
and dem no go condem you!
Forgive,
make dem fit forgive you.
Show we yor way, o God!
Give, and dem go give to you.
As you take do for persin na so dem go do for you too.
One blind man no go fit lead anoda!
If e try am, dem two go fall inside pit.
Why you dey see di small dirty wey dey your broda eye wen you nova comot di wood for yor eye?
Guide us, O, Oga!
We need You now, God!
Ah, mama wey bon you and give you breast go happi well well!
All, na people wey hear God word go happi pass,
and wey do am.
I for like to no dis man.
You tink say na di, Savior, be dis?
Di Farisi come call Jesus to come chop wit am. Den Jesus come go 'im house and e come sidon to chop.
Pickin, oya make una dey go. Una hear me. Go!
Dem like to play yeye play well well.
Wetin she dey do here?
I no no!
Wetin she dey do?
If dis man na realy prophet, e for fit no who dis woman be wey come dey touch am so
E for fit no di kine bad life wey she dey live.
I sabi who dis woman be, Simon
Make I tell you sometin:
E get two man wey dey owe money lender money:
One dey owe plenty money, di oda one owe small money.
Two of dem no fit pay am back, so e forgive di two of dem.
Which one of dem go like am pass?
I feel say e go be di one wey 'im money plenty pass.
You correct.
You see dis woman?
I come your house, you no give me water wash my leg,
but she don wash dem wit water from 'im eye and clean dem wit 'im hair.
Una no welcome me at all at all.
But since I come she never stop to welcom me.
Una no fit bring olive oil for my head
But she don take scent rub my leg,
Make I tell una
This love wey she show me, don show sey I forgive am all her bad.
But who I forgive small
Na only small love e go show.
I don forgive all yor bad.
How e go talk like dat? How e fit take forgive bad tins?
Your believe don save you. Make peace follow you.
And Jesus dey travel dey teach di good news of God kingdom.
And di twelve follower dem dey go wit am wit some women dem wey him don cure from bad bad spirit:
Mary wey dem dey call Magdalene,
Joanna, wey 'im husband Chuza be cook for Herod;
and Susanna.
Herod, wey di Roman people choose to be di king of Galilee, come put John di Baptist for prison,
becos e talk say e no good as Herod marry 'im broda wife.
Na wah.
As we come reach Nain gate, We see dead body wey dem carry.
Na di only pickin wey one woman get.
As Jesus come see am, 'Im heart come sorry for am well well. E touch di coffin, come say,
"You boy, I say, oya get up!"
Den di boy wey die sidon. And Jesus give am back to 'im mama.
Ask am,
say,
Na you be di one wey John talk say go come?
Abi make we wait for anoda?
Oga!
Oga?
John di Baptist send us come ask, weda na you bi di persin wey go come?
Abi make we wait for anoda?
Go tell John wetin you see and hear:
Di blind fit see. Who get half leg waka.
Happiness dey for people wey belive in me!
I beg, karri me!
Climb my shoulder. You fit see am now?
I dey see Jesus now!
One farmer go out go plant 'im seed.
And as e scatter di seed, some o dem fall for road and people come match dem.
Birds wey dey fly come chop on, some of dem.
Some sef fall on top strong ground,
When di plant come grow, dem come die becos dem no fit get plenty manure.
Some seed fall for chuku chuku,
Chuku chuku grow wit di plant,
And kill dem.
And some seed fall for good ground,
and di plant grow, den bring fruit:
One bring hundred fruit.
Oga,
Why you dey talk so so parable when di pipul dey around?
Una don know di secret wey konsine di kingdom of God.
To odas, e dey come as parable. Di more wey dem look, di less dem go see.
And lisin, dem no go fit know.
Dis na wetin di parable mean:
Di seed na God word.
Di seed wey fall for di road na dem wey hear di word.
But devil com take God word come for di pipul mind, make dem no fit belive and come dey free.
Di seed wey fall for strong ground stand for dose wey hear God word and receive am wit happiness,
but dem no get root.
Dem belive for only small time.
And wen di time of temptation come,
dem com fall.
Di seed wen fall for chuku chuku na dem wey hear.
But di wahala, wit money plus enjoyment of dis life come swallow dem,
And dia fruit no come ripe.
And di seed wey fall for good ground,
stand for pipul wen hear God word and keep 'im inside dia heart, and come fear God.
And come hear ram until dem bring fruit.
Persin no go light lamp and cover am wit plate,
or come put am under bed...
Instead e go put am on top of table,
make pipul wey di com take am see road.
Anytin wey dem hide, go come out for everybody to see.
And anytin wey dem corva go open and we all go see am.
No di kain tin wey you dey hear.
Becos, who get before, dem go give am more.
But 'im wey no get, even small one wey e be say e get, dem go take am from am.
Teacher,
Your mama and brodas dem stand for outside.
Dem want to see you.
My mama and brodas na dem wen dey hear God word,
and obey am.
One day Jesus come enta one boat wit 'im followers,
and E come tell dem make dem come cross go di oda side of di river.
And as dem dey go, E come begin sleep.
Oga!
Oga!
Jesus!
We wan die now o!
Di wave don dey cover us, we all go sink! Save us Oga!
E wan come save us now!
Wey una belive?
Dem come travel go Gadara wey dey di oda side of river Galilee.
Jesus,
Son of di most high God
Wetin you want from me?
I beg you,
no punish me!
Wetin be your name?
Legion.
Oga, we beg you:
Make you no send us go hell fire.
Make we enta
inside di gang of pigs.
Hey!
Come back!
Stop!
Stop!
Di demons come comot for di man body,
Come back!
come enta di pig dem.
Comot from here!
You, magician!
Leave us!
Comot from dis place!
Leave us!
Comot from here!
I go follow you any were wey you go.
Make I follo you.
Go yor house,
and talk wetin God do for you.
Jesus and 'im followers come go stay for Bethsaida.
But many pipul come no and come follo dem.
Near evening time, Peter come talk say:
Oga,
Send di pipul comot
So dat dem go fit go di village dem and farms wey near here,
To find food and place to stay. Nothing dey dis place O.
Make una give dem sometin to chop.
But...Wetin we get na five bread wit two fish.
I thank you o Papa, King of all the whole world wey dey bring food come out from di ground.
Dis na miracle!
I no fit believe!
Who di pipul dey say I be?
Some say na you be John di Baptist
Odas say na you be Elijah.
Den, odas say you be one of di prophets of befor,
wey come back to life.
What about you?
Who you talk say I be?
You be Savior from God!
No tell any man dis thing.
Man Pickin go suffer well well, dem go refuse am.
Dem go even kill am.
But E go wake up again after tiri days.
Any of una go follow me?
I go follow you, Oga.
But first, make I go tell my family bye bye.
Anybody wey start work for God wey still dey look back no get any use for God kingdom.
If anyone wan come wit me, e must forget 'insef.
Take up 'im cross everyday and follo me.
For anybody wen one get life go lose am.
And anybody wey go lose 'im life for me, go save am.
Wetin man go gain if e gain di whole world and come loss 'im own soul?
If any man dey shame for me and di tin wey I teach,
Den, Man Pickin go shame for am too wen e come back wit pawa.
Wit di pawa of my Papa and di holy angels.
Make I tell you
Some people dey for here wen no go die until dem don see God.
Den Jesus take John and James and Peter wit am go on top of hill go pray.
And as e come dey pray, all 'im face come change from di way e be before; 'im cloth come dey white well well.
At once, two men come dey talk wit am. One be Moses, di oda one Elijah wey appear like spirits.
You go do wetin God talk.
You go die for Jerusalem!
As dem dey comot dere, Peter come tell Jesus say...
Oga, e good as we dey for here!
We go build tiri house:
One for you...
As Peter dey talk, smoke come corva dem. Di follower dem come dey fear.
One voice come talk from di smoke say: "Dis na my Pickin. Di one wey I choose. Lisin to am."
Oga!
Oga!
I beg make you look my pickin.
I beg, I beg help am.
Na 'im be my only pickin.
I beg your followers to cure am,
But dem no fit.
Oh, wicked pipul wen no get belive!
How long I go dey wit una and bear wit una?
Bring your pickin come.
'Im face sef don come cure!
Na wa o!
Teach us how to pray,
just as John teach 'im followers.
When you dey pray, say:
Our Papa wey dey for heaven,
we bow for yor name.
Make yor kingdom come.
Make yor will dey for earth as e dey for heaven.
Give us our food today.
And forgive us di bad we do,
as we too dey forgive pipul wey don do us bad.
Help us make we no enta wahala,
but take us comot from bad tin,
Ask, and you go kollect.
Look, and you go see.
Knock, and di door go open for you.
Anybody wey ask, e go kollect,
and 'im wey look for e go find.
And di door go open to anybody wey knock.
Una don see any papa wey give 'im pickin snake,
wey e ask am for fish?
Or scorpion wey e ask am for egg?
As una bad reach, una sabi give good tin to una pickin.
How much more, Papa wey dey for heaven, e go give 'im Holy Spirit to dem wey ask.
Make I tell una,
no dey tink for yor life, wetin you go chop
or cloth wey you go wear for yor body.
Becos life pass food and your bodi pass cloth wey you dey wear.
Tink about di birds.
Dem no dey plant or harvest or get store.
Upon all, God dey feed dem.
Una no betta well well pass di birds?
Wich of una wey dey worry
Go fe add join di life wey e get?
If you no go fit do dis kain small tin,
Why you dey worry about di rest?
Think about di flowers how dem dey grow.
Dem no struggle or work,
still yet, Solomon, as e get money reach 'im cloth no fine reach any of dem.
If God
wey make grass fine, wey e be so e dey today, tomorrow dem troway am,
wetin make una tink say e no go give una cloth.
Why una faith small sef?
Make we belive big.
If your belive be chekere sef you fit tell
dis ebelebo tree,
say, "Up root yorself comot ground; go plant yorself for river." And di tree go do am!
Temptation to sin must come mit you.
But yawa go follow who bring am.
E for betta for dat persin if dem tie block for 'im neck and trow am for river
dan for am to make any of dis small pickin go do bad tin.
Na wetin God kingdom be like?
E be like dis:
One man come take guinea corn seed plant for 'im farm.
Di plant come grow reach big tree.
Bird dem come build dem house on top di tree.
I no know wetin e dey talk so.
Why you dey chop and drink wit wayo and jaguda people?
Pipul wey no dey sick no need dokita But only dem wey dey sick.
No be beta pipuI come tell to comot hand from bad tin,
Na jaguda pipul.
Tell we again about di kingdom
Any tin still remain?
Make una no fear, pickin, becos una Papa dey happi to give una di kingdom.
Sell all di tins wey you get and dash poor pipul dem.
No keep your money for where e fit from loss but save am for heaven where e no fit loss.
Becos nor tin go fit tif am
And no wan go fit chop am.
Becos were yor money dey, na'im yor mind go dey.
Woman,
You don free from yor sickness.
See! See! She don well! Na miracle! See, she don well! Come see am!
Pr-pr-pr-praise
Di Lord o!
Since eighteen years!
God keep you, Teacher!
Na six days dey wey we go fit to work.
So come make dem cure you for one of dem.
But no be for Sabat day!
Wayo people!
All of una wey dey here go take una Jackie and una malu comot for yard go give dem watar drink for Sabat.
Look dis Abraham pickin wey devil don tie for ground since eighteen years.
Abi dem no fit still loose am for Sabat?
Good teacher, wetin I go do to get life wey no go end?
Why you dey call me good?
No person good but only God.
You sabi all di law:
No follow anoda man wife.
Make you no kill persin; no lie for persin head.
Respect yor mama and yor papa.
Since wen I small na'im I don dey do wetin di law talk.
But e get one tin wey you go still do:
Sell everytin you get, and give di money to poor.
And you go get money for heaven.
Den, come and follow Me.
But we be traders,
money dey.
E hard well well for persin wey get money to enta God kingdom.
E go hard well well for persin wey get money to enta God kingdom,
pass as Jackie go fit enta di hole wey dey for needle.
Who go come fit save?
Wetin man no go fit do, God fit do am.
Na which time sef e go come...
God kingdom?
God kingdom no go come for di way wey you go take fit see am.
No one go say,
"See,
e dey dere or e dey here"
Becos God kingdom dey inside yor body.
Time dey come wey e be say you for like to see one of di days of Man Pickin.
But you no go see am.
As lightening go shine for up waah! From one side reach di oda side na so e go be for Man Pickin dat day.
But e must first suffa well well and pipul of 'im time go refuse am.
E dey easy well well for heaven and for earth to vanish comot pass make dem comot di word wey small pass for di law.
I tell una, many prophet wit king get mind to see wetin una see but dem no fit.
And to hear wetin una hear but dem no hear.
Wetin we go do?
Wetin di Bible talk?
How you take know wetin e mean?
Love di Lord yor God wit All yor heart,
Wit all yor soul, wit all yor pawa, and wit all yor mind,
and love yor neigbor as you love yorself.
You talk true.
Do dis and you go live.
Who be my neighbor?
No be dis soja!
What of Caesar, naw?
E get one man wey dey go from Jerusalem to Jericho.
E come jam tief people.
Dem beat am, naked am, e nearly die.
Na 'im one pastor come dey pass dat road. Wen e see di man e go pass di oda side.
One Levite too still come pass dat road. Wen e come look di man finish, e jus waka go pass anoda side.
But one man wey come from Samaria dey travel for dat road.
E come see di man. Wen e see am e come sorri for am well well.
E come go mit di man, E come pour oil wit drink for 'im sore and tie dem.
E put am for 'im Jackie and take am go one hotel, where e take care of am.
Di next day, e come give di hotel man two silver penny. E come tell am say make e look di man.
Say, wen I come back, I go pay anytin wey you spend for di man.
Which of dem na 'im come do like say e be di neihbor to di man wey tief pipul beat?
Di one wey do good to am.
Make una do di same too.
Ah!
Make una let di small pickin dem come mit me, make una no drive dem.
Becos na so God kingdom be.
I dey tell una true true,
Any person wey no go fit great take God kingdom like small pickin, no go ever fit enta inside.
Persin wey welcom dis pickin becos of me, welcom me.
Di one wey welcom me welcom the persin wey send me.
Di one una no take as anytin na'im big pass.
Eh! Wetin happun? Wetin dey happun?
Jesus wey come from Nazareth dey pass.
Jesus!
Jesus!
David pickin, Sorri for me naw!
Wetin you want make I do for you?
I wan see again.
Oya see.
Yor belive don make you well.
I dey see!
I dey see!
I dey see!
As Jesus dey go Jerusalem, plenti pipul come mit am for road.
Di people come dey tell am say make e tell dem how dem go take free and make e teach dem about God kingdom.
Dis man na prophet true true o!
My Lord, my Oga, save me!
Oh! Lord, save us, save us!
Praise di Lord!
Oga, show we di true way.
Di people come begin gree say e be Oga.
For Jericho, e get one tax collector wey 'im name na Zaccheus.
Di man really wan see Jesus, so e climb tree so dat e go tall pass everybody.
Na di tax collector.
Come down quick, quick, Zaccheus!
Na yor house I go stay today.
My house?
Who go want you for 'im house?
How Zaccheus take no Jesus sef?
Lisin.
I give
half of my properti
to poor people,
and if I don
play person wayo
den I go pay am back,
up to four times.
I no belive! Tax collector go return money wey e collect! Dat na lie!
Na freedom don come dis house today so.
Becos dis man na still Abraham great great grand pickin!
Man Pickin come find pipul wey loss and save dem.
Lisin.
Oya we go Jerusalem,
were eveytin prophet dem write about Man Pickin go happun.
Dem go come karry am give wicked pipul
Dem go laugh am,
and dem go make am yeye dem come spit for 'im face.
Dem go whip am and kill am.
But after tiri days,
e go wake.
Even though Jesus know say wan for world people sake,
e still take di road to Jerusalem.
Many pipul happi say Jesus don come and come dey call am King.
Teacha, tell your followers dem make dem shut up.
Di tin be say, if I tell dem to shut up,
di stone den sef go begin dey shout!
Peace wit joy yanfu yanfu don dey heaven!
Wen Jesus come near Jerusalem, and e see di town, e begin cry for am.
If to say,
una fit know di road to peace today, but una no dey fit see am .
Day dey come wen una enemy,
go gada una and show una pepper from all corna.
Inside dia na'im dem go kill una...
...you and yor pickin.
And dem no go leave one stone on top of anodaone becos you no fit no di time wen e go happun.
Di church wey dey inside Jerusalem don turn to place wey dem dey do market instead of to sarve God.
Dem write am say,
"My house go be house of praya."
But una don turn am to be tief pipul house!
E dey go pursue all my goat!
Stop am!
Stop am!
Call soja! Call di soja!
Wahala come dey between di pipul wey be oga for govment and church becos di pipul talk say Jesus na'im be King.
I hear say many people dey hail am say na'im be king.
Which king?
King of babi-ala wit tiefs.
We don see dis one before:
Wen dem talk finish dem go go, dem forget dem.
You dey blind?
Di pipul many wey dey follo am.
Di pipul like am well well.
Dem tink say e be king
Make I give una warning: If dis man just bring wahala again, I go hold una!
E fit be true.
Di time don reach to ask di Galilee man.
As e come di vex well well wit di lie lie scribe dem wit di Pharisee wey dey make wayo law,
na so di Jews come dey like to follo am.
And so dem wen e vex for get more bad belle for am.
Wen e dey inside church, Jesus see one poor woman wey put two kobo for offering.
E small well well.
You no fit put more?
I tell you:
Na dis woman money na'im plenty pass odas,
becos oda pipul put from di plenty wey dem get for house.
But as she poor reach, she fit put everytin wey she get for house.
Tell us:
Which pawa you get to talk dis tin?
Who give you pawa?
Make I ask you one question:
Tell me, di pawa wey John take baptize, na God give am abi na man?
Wetin we go say?
If we say na God talk am,
E go say, den why...
una dey doubt John?
"But if we say na man, dis people here go stone us.
All of dem believe say John na prophet!
We no know where e come from.
Me sef no go talk di pawa wey I take dey do dis tin.
E get one man wey plant orange for 'im farm,
e come give am to farma dem,
e come comot for 'im house tay.
As time don reach to pluck di orange,
e send one servant to di farma dem
to go collect 'im own share of di orange.
So di farma dem beat di servant and dem no give am anytin.
E send anoda servant.
But di farma dem beat am too, do am anyhow and send am back wit notin.
E come send di numba tiri servant. But di farma dem come wound am and drive am out too.
Di owna of di farm come talk for 'im mind: "Wetin I go do? I go send my pickin"
"Dem suppose to respect am."
Wen di farma den see am dey come, dem come say:
"Dis na Oga pickin.
Make we kill am and den take 'im property."
Tell we more, Lord!
So dem drive am comet for di farm.
Den kill am.
Wetin di person wey get di farm go come do to di farma dem?
E go kill all those men, dem e go come give di farm to oda farma dem.
Wetin dis Bible place mean?
Di stone wey di pipul wey dey build house say no good,
na'im come betta pass all di odas.
Any person wey fall on top of dis stone, e go scartta to pieces.
If dis stone fall on top of persin,
e go grind am smoot.
Teacha.
we no say wetin you dey talk korrect.
We no say you no dey care for wetin persin be,
but you, dey teach di plan wey God get for man.
Tell us,
Our law talk say make we pay tax to di king wey dey Rome, abi make we no pay?
Oga, take care o! E wan try you.
Bring one silver money
Which persin face na'im dey dia?
Caesar!
Den make una give Caesar,
di tin wey be Caesar own,
and to God
tins wey be God own!
Wetin be your answer?
Time of di festival of flat bread wen dem dey call Passover don dey near.
So Jesus send Simon Peter wit John for front make dem go cook di festival food.
I get am for mind to chop dis festival food wit una before I suffer.
I tell una say,
I no go chop am again until una don no wetin dis food mean for God kingdom.
Na betta God you be my God.
You be di King of di world.
Na You make tree bring out fruit.
Take dis one make una divide am.
Hear me, I no go drink from di fruit wey di tree go bring until wetin God talk happun.
Na betta God You be, my God.
You be king of di world.
Wey dey bring food come out from ground.
Dis na my body wey I give for una.
Do dis tin to rememba me.
Dis cup na di new belive for my blood, wey I sacrifice for una.
But di persin wey don go sell me outside follo me dey dis table.
Na true say Man Pickin must die as God don talk am but na curse go follo di persin wey make am happun.
E no fit be!
E no fit be!
E no go happen.
Call di persin name!
Di big persin for una must be like small pickin.
And di oga must do like boi boi.
Na who come big pass?
Persin wey sidon to chop?
Abi na who serve?
Na di persin wey sidon, abi?
But I dey wit una like who dey sarve.
Una dey wit me since dis wahala.
And as my Papa don give me di pawa to kontrol,
na so I go give una too.
Una go chop and drink for table for my kingdom,
Una go sidon for govment to kontrol twelve tribe wey dey lsrael.
Na'im be say no bad persin!
Simon, Simon, see o!
Devil don beg God to try all of una,
To separate good tin from bad tin just as farma dey separate corn from dirty.
But I don pray for you, Simon, make your mind no shake.
Wen your mind don strong, make you help your brodas to believe.
Oga, I dey ready to go prison wit you, And to die wit you!
Peter I tell you, before fowl go shout kukuruku you go say you no no me tiri times.
Wen I send una go out wit out purse or bag or shoe, una suffa anytin?
No,
we no suffa.
Now, persin wey get money or cloth must karry am,
and who no get Bible must sell 'im cloth take buy one.
Make I tell you,
as dem write inside Bible, "Dem count am join pipul wey do bad"
And wetin dem write about me don dey happun.
Look,
Na two sword be dis, Oga!
Dat one don do.
Di eldas dem come gada to talk how dem go take finish Jesus.
Na'im devil enta inside Judas Iscariot wey be one of 'im follower.
E come plan wit di eldas to catch Jesus.
Jesus come commot from Jerusalem go mountain Olive go pray.
Pray make una no go fall inside wahala.
Judas Iscariot sell 'im Oga for just thirty pieces of silver.
Jesus no say time to die for di bad tins wey world pipul do don reach;
E come pray say:
Papa,
if You go gree, remove dis suffa from me.
Any way sha, not as I want,
but as You want am.
Na'im angel come appear from heaven to give am pawa.
Di sweat wey comot from im body be like plenty blood wey fall for ground.
Why una dey sleep?
Get up!
Pray make una no enta inside wahala.
Judas...
...na wit dis kain kiss you wan take sell Man Pickin?
Oga, make we fight wit dagger?
Come on, arrest am!
Dis one don do!
Na miracle!
Una come carry dagger wit stick like say I be jaguda.
Me wit una dey go di same church everyday but una no fit arrest me.
But dis na una time sha,
wen wicked pawa dey kontrol.
Arrest am!
Guard am well.
Di sojas take am go inside di compound, dem come take am make yeye.
Dis na dress wey king dey wear.
Tell us we wetin go come happun!
Our king, you don come to save us now? You don come save us?
Dis man sef, dey wit Jesus
Madam, I no even know am!
I been see two of dem!
Na we be your boi boi!
How e be like to get persin for front?
You sef na one of dem.
No be me!
Na real true say dis man sef dey wit Jesus
Becos 'imsef na Galilee e from come."
Commot here!
I no know wetin - wetin una dey talk!
Jesus come turn look Peter for eye.
Na'im Peter rememba wetin E tell am before.
"Before fowl go shout kukuruku, you go say you no no Me tiri times."
Oga!
We dey beg You.
Do as You fit.
As Your pawa take strong reach to do big tins.
You,
wey forgive our papa dem wey no do as You tell dem;
You,
wey been dey vex wit dem,
but You no still kill dem.
Becos of di likeness wit agreement wit goodness wey,
You get for dem, You no kill dem.
Talk who nack you?
See vision! Who go nack you again?
Stop am!
I say stop am!
Karry am go mit di eldas!
Go!
Di church big oga dem come gada to ask Jesus question.
Tell us,
Na you be di Savior?
If I tell you,
Una no go belive
If I ask una question, una no go answer me.
But from now go, Man Pickin go sidon for di right hand side of our Almighty God.
Na you be,
Pickin wey God born?
Na so you don talk.
Na who give am di pawa to talk dat kain tin?
E do wrong!
We sef don hear wetin E talk!
We go take am go mit Pilate!
Yes, yes, carry am go!
Waka!
So dem come carry am go mit Pontius Pilate and na'im wicked pass for all Roman oga soja.
E don hang many many people.
Wetin you want for here, for dis kain early morning?
We catch dis man dey confuse our pipul!
E bring kata kata for inside di market!
Wetin we go take punish am?
Jail am now!
No reason why I go jail dis man. Reason no dey!
We see say E no do bad, E tell dem say make dem no pay tax to di king.
E say na 'im be di Savior
And king.
Na king?
Na you be di Jew pipul king?
Na you talk am.
Na Galilee na 'im e start, now e don come here!
For Galilee?
So dis man come from Galilee?
If na so,
Make Herod deal wit am.
I think e still dey there for Jerusalem?
Carry am to Herod!
Na who you even say you be?
Which pipul you say dey follo you?
Many pipul talk say you dey do wondas.
Do one make I see now.
My Oga,
E don dey spoil all di pipul mind since,
E say na 'im be king!
King?
Dis man na king?
Oga king.
Nack am well!
Take am back to Pilate. Na 'im area be dis.
Dis Man
Neva do wetin reach to kill am.
So make dem cane am well well.
And den make E go.
Di law say you must free one man for us for dis festival time.
Den, free for us,
Banabbas.
Yes.
Karry dis man commot!
Yes, Give us Banabbas!
Nail am for cross!
Yes, nail am for cross!
You, you, whip am.
Wetin you dey wait for Pilate!
Na Jesus!
Why you dey suffa am like dis?
Leave am, na 'Im be di Savior!
E no do anytin!
Carry am up!
So di pipul come still dey shout well well say make dem kill am; make dem nail am for cross.
Na'im Pilate come orda say make dem kill Jesus.
E come free Banabbas, wey dey prison becos of wahala wey e don cause plus pipul wey e been kill,
den e carry Jesus give dem go kill.
Back!
Go back!
Back! Commot here!
Una no near am.
Go back!
Go back!
Back!
Commot here!
Give chance!
Get out!
You, commot for road.
Move when I tell You!
Get up!
Get up!
You!
Wetin be yor name?
Oga, I be Simon from Cyrene.
Come dis side!
Cut di rope!
You, carry am.
Come on, move!
Back!
Back,
Leave am!
Waka now, commot for di road!
Back,
Go back!
Go back!
We cry for you, Oga. Drink dis wata — drink!
Oga, drink.
Mama dem for Jerusalem,
Make una no cry for me,
Cry for una sef wit una pickin.
Becos if dis kain tin dey happun wen I still dey,
How e go be wen I don go?
Make God help You.
We go pray for You.
Waka!
Go there!
Come on!
Quick, quick!
Quick, quick!
Oya go!
Oya start to go fast! Quick!
Come on!
Quick, quick!
Oya!
Move!
Now, you go front!
Start to do am!
Raise am!
Put the peg inside!
Loose di rope!
Forgive dem, Papa,
Dem no know wetin dem dey do.
E been don save odas,
make e save 'imsef.
Ehen, save yorself if you be di Savior! Come down from di cross!
Show we one of yor miracle!
Dem hang Jesus for cross for di middle of two tief,
dis tin happun as di prophets of God talk inside Bible many hundred years before.
Dis robe no be ordinary magician cloth o!
Leave me! No, no tear am! Make I tell you:
Make we take am bet!
You get luck o! Na wetin you go take am do as you don win am?
Dem come put signboard on top of 'im head wen dem write put say, "Dis na di Jew pipul king.
Save yourself now, if na you be di Jews' king!
No be You...
be Messiah?
Save...
yorself...
and — and we!
You no fear God?
E get di same punishment...
like you...
but E never do bad.
Rememba me, Jesus,
when — when You come as King.
I promise you,
today you go dey for heaven...
wit Me.
From twelf O'clock go reach tiri O'clock for afternoon, di whole place come dark like night.
Di curtain for church come tear from top to bottom for di middle.
Papa...
na inside yor hand...
I put...
My Spirit.
So wen di oga of di soja dem see wetin happun, e come begin praise God say.
"Glory be to God! True true dis na good man wit clean belle!
Joseph wey come from di town wey dem dey call Arimathea.
Wey be big man for di church, but e no put hand for di kill wey dem kill Jesus
come tell Pontius Pilate make e gree make e bury Jesus before evening church time.
Forgive us. We sef dey follo our Oga body.
Una welcom.
But come,
Di Sabat day don dey near.
For early morning on Sunday, dem carry di scent wen dem don prepare come di place wey di grave dey.
Dem see say di stone don roll comot for di grave. But wen dem enta, di body of Jesus no dey there.
Why una dey find who don wake up for were dead body dey? E no dey here, E don wake up.
Rememba di tin wey E talk for Galilee:
God Pickin go fall inside bad people hand, dem go nail am for cross, after tiri days, E go wake up again!
Hear me!
Dem don roll di stone comot!
As we enta,
Our Oga body no dey...
There!
En! Our Oga body no dey there?
And two men come appear;
Angel wey shine,
Like sun,
Dey come tell dem say:
"Why una dey find who dey alive...
for burial ground?"
Na true!
Belive us.
Belive us.
We see dem! Go see for yorself! Di grave dey empty! Oga body no dey there!
Peter, you must belive us!
So Jesus come appear to two of 'im follower. Dem come happi go mit di odas.
Our Oga don wake up true!
E don appear to Simon!
We no come fit know am sef...
even for road.
Wen E broke di bread,
We come know am!
For Emmaus.
Na surprise say E dey there!
I greet una!
Why una dey worry?
Why una come dey get double mind sef?
Look.
See my hand and my leg.
Make una see say na me be dis.
Touch me and you go know.
Spirit no dey get flesh wit bone as una see say I get.
Dis na di tin wey I been dey tell una wen I still dey wit una.
Everytin about me wey Moses write for law;
di ones wey prophets write plus di ones wey dey for psalm must happun.
Dis na wetin dem write:
"Di Savior must suffa,
and wake up from grave after tiri days."
Wit Jesus name,
tell everybody for di world say make dem change and tell dem say God don forgive dem,
Starting from Jerusalem.
Una take eye see all dis tin
And Me sef bring di promise wey Papa talk for una.
But una must wait for dis town,
until pawa from up come enta una body.
Make God bless and keep una.
All di pawa wey dey for heaven and for dis world, na me get am,
so make una teach di pipul wey dey di world and baptize dem wit di name of di Papa, di Pickin and di Holy Ghost.
Make una teach dem say make dem follow all di tin wey I command una.
I dey wit una every time, even till wen dis whole world go end. Amen!
Di grave wen dem put di dead body of our Oga Jesus dey empty.
Tiri days after dem nail am for cross, E wake up from grave. E dey alive!
E wan enta una life.
Jesus 'Imsef talk say:
Na me be life, who believe me go live, even if e die.
Two thousand years don pass since Jesus get up from grave.
And E still dey alive today as di Persin wey get pawa pass and na 'im people no.
Many important pipul from before before don come and go.
King o, pipul wey sabi book, pastor, pipul wey dey read star and moon don come, dem don go.
Jesus dey alive today. Na 'im be di greatest Persin wey don live for di world.
Bible talk say 'Im life different as Mary wey no know man na'Im bon am
'Im life different. Penti tin wey pass dis world na'im dem see for everytin E do,
E no do any bad tin at all. Di miracle wey E do no oda persin fit do am.
'Im tori dey different. E dey give love, forgiveness,
plus show you new road wey you go waka if you make am your Oga, and di Persin wey save you..
Everywhere wey 'Im tori don reach, new way to live life don come.
Di die wey Jesus die for cross e dey different.
Since two thousand years, God come send 'Im only Pickin, Jesus Christ
to come be di sacrifice for di bad tin wey everybody do. E die for you.
As E get up na wonder.
Tiri days after E die, na surprising tin happun for dis life.
Jesus get up from die!
As dem born am, as E die, as E get up, show say, Jesus na wetin E say Him be.
na God Pickin, and E come save us..
Dis Jesus Christ still dey alive today. E wan come into yor life.
E wan remove all di yama yama tins and give you pawa to live ogbonge life. Hear wetin E talk:
Come wit me, all una wey dey suffa and wey no happi, I go give una rest of mind.
Na me be road, di trut and life. Nobody fit come mit Papa if no pass through Me.
Bible talk say we all don do bad, even God pawa sef don commot our life.
Di pay wey we get for di bad tins na to die,
but di good tin wey God give na for Jesus to make us live for ever.
Di time wey Jesus die, E pay di gbese for the bad tins wey you do. E ready now to come inside yor life.
Look, I stand for doormat dey knock. If anybody wey hear my voice open di door, I go come inside come mit am.
For you to get 'Im love and forgiveness, and to fit go heaven,
you go first take am as di sacrifice wey God give for all yor bad tins, tell am make E come inside yor life.
If dis na di tin wey you want for your heart, pray dis prayer of belive, Jesus go come inside yor life.
Na dis kain prayer you go pray, I go talk am first:
Oga Jesus, I want you. Thank you as you die for cross for all my bad.
I don open my belle for you. I take you as di Persin wey save me.
Take control of my life. Make me di kain persin wey you want me to be. Amin
If dis prayer na di tin wey you want for heart, pray dis praya now, now as you dey there.
Make you talk wetin I pray now small small as I go talk now
Oga Jesus I want you.
Thank you as you die for cross for all my bad.
I don open my belle for you.
I take you as di Persin wey save me.
Take control of my life.
Make me di kain persin wey you want me to be.
Amen.
As you don pray dis prayer of belive, and you don allow Jesus come inside yor life,
make you know say E come inside you becos E talk say E go come inside only wen you want am.
Make you know say all di bad tin wey you do, E don remove am, you be God pickin now. You go go heaven!
If you want get di good life wey Jesus say E go give you, talk to am wit prayer everyday.
Find out di better plan wey E get for your life as you dey read di Bible.
Make you mit people wey dey follow am too.
Last last, make you remember di better better tin wey E promise you o!
I no go leave you, or forget you. I dey wit you all di time, even go reach di time wey world go end.